Tuesday 10 December 2013

Psalm 23 for naija pidgin English don com out ooooo

One of the popular chapter is psalm 23,
which reads
1. The Lord na my shepherd, i dey kampe.

2. E make me sidon for where betta dey flow
and come put me next to stream make mai
bodi thermacool.

3. E panel beat mai soul
Come spray am white,
Come dey lead me dey go Through express
road of righteousness sake of Hin name....

4. Walahi!, if I waka pass where arm
robber,
419 and juju people boku, come even join
boko haram reach valley of the shadow of death sef, mai bodi dey inside cloth.
Your rod and staff nko ?
Na so dem dey like back bone dey comfort
me.

5. You don prepare good food ontop d table
make I chop. All mai enemies dey look waa waa.
You rub me for head wit vaseline
intensive lotion.
mai cup na River Niger wey overflow hin
bank.

6. True true, betta life and mercy go gum mai back till I quench.
And man pikin go tanda for God house
from lai lai to lai la
Can somebody shout halleluyah

No comments:

Post a Comment